Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: African bitcointalk community hangout
by
CryptopreneurBrainboss
on 17/07/2020, 18:12:52 UTC
Na wah oh e get persin wey never fall mumu to dose scams before? Take God self for some of them because if no be MMM I no sure una for don see me for dis forum. Back in the early days I mumu die, na hyip, doublers, Ponzi abi matrix or wetin dem dey call am self, I no do? I do all but thank God today persin eye don open. All na experience and we don grab am major.

@Becky666 my eye still dey for that coin but small development been sure up so I get to sell sharp sharp to buy back my DGTX (thank God e don rise). I still go buy some of the ARPACHAIN before month end. This two coins na my major bags.

@Nelson4lov where you lost go, well thank God we don dey come back small small