True, wait make I tagged all of dem as alt and the onli way dey fit prove say dey no be alt na to comment and actively participate for this thread lol.
Lol... I sabi sey na joke you dey. Leave dem, I know sey with time most of them go show here. You nor go too blame them as dem dey avoid people knowing sey dem be Naija peeps. Owa politicians dem don too give us bad name outside sotey once you tell anybody sey you be Nigerian, dem go begin hold their wallets tight. But people forget sey good Nigerians full ground too. See the type of charity wey you even organize for PH, dat na better thing from a concerned heart.
No reason am like dat oh, dat coin na $1+ coin if you get am under 5cents you still dey in luck.
Bros, I want make the thing drop small na so I go fit pack enough with small money. I don enter prayer for that coin head wey go drag am down whether e like am or not 🤡🤡.
BTW, check your pm for telegram and give me reply, abeg.