Username: Lordhermes
Country and state of resident: Nigeria/Portharcourt
Developing Skills: Trading.
Omo, I dey hail every body for here oh, I just come across this thread now meh e make sense wella, I feel say I dey home dey yarn with people wey know the matters. You too much Brainboss.
E get wetin I for suggest for this introductory post, we no know weda we be male or female. Gender suppose dey make we know male and female, wonder fit happen for this forum say people marry from forum as e dey happen for facebook. LoL, abi no be so?
Abeg, Brainboss, no vex say I yarn something like this for wetin you been don create.