Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: African bitcointalk community hangout
by
Mpamaegbu
on 21/07/2020, 11:53:37 UTC
Me are dey beg una make we dey try dey help our people here even when we go to public board make still help our people them.
Na true you talk about wetin dey happen for other people dem local board. I don notice tey tey how those ones dey take style rub body. We too wey dey here dey try too. I even get like three good posts wey I suppose merit since last week sef but I nor get merit to do am. Na small small bro. Just make sure sey your posts dey make sense and e go surprise you as merit go begin dey touch dem soon.

My people say waiting wey don affect one person for group were dey belong don affect everybody wey dey the group.
E bi like sey you dey like throw proverbs. O ya, make you join me for that my thread on African proverbs for the local board.