Welcome on board as you come join us here make sure say you dey represent us well avoid anything wey fit spoil our image here you no say Hushpuppi and co. don spoil naija image and these oyinbos go dey take one eye dey look us for any fuck-up.
make sure say you bring more country people come here so that we go push our local board up like others and to dey compete with them as you talk am so that we too go dey help ourselves I dey always happi to come this board to come and feel at home na good talk you talk make we dey try and help others.
My brother thank you well well for the advice wey you give me and the merit too you don give me
Because with una like this we go dey get merit for this our Africa board.
For public board like this e dey hard before person go get 1merit.
Like these na I dey happy for the merit wey u don give me like these, my heart dey sweet me sugar sugar since are don see new merit
Biko are dey beg other senior brothers make una dey help us here to dey grow like others.
This our board go help us well well.
Thanks brother are no fit forget you.