Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: African bitcointalk community hangout
by
nelson4lov
on 21/07/2020, 22:26:59 UTC

My name na George john
Are be male in gender
And I from Nigeria
Are be full son of africa.

Biko my people of Africa make we try dey help our begginers wey no no anything here so that dey go follow those people wey dey local board from another country dey compete.




George welcome to our tiny corner on bitcointalk (it's no longer tiny, lol).  I wan specially welcome you.  We dey long overdue to get our own board for this forum. I know say we go get am soon.


Welcome on board as you come join us here make sure say you dey represent us well avoid anything wey fit spoil our image here you no say Hushpuppi and co. don spoil naija image and these oyinbos go dey take one eye dey look us for any fuck-up.

The issue of trust na very big problem Oo especially for honest nigerians wey dey try hustle to help themselves and their families.  Na why e be say most recent opportunities dey limited from Nigerians. The only thing we fit do na to just try our best and stay true to ourselves. Coz e dey much harder now.

I see that coin oh even KEY all just dey blow dey no wan carry me along. Even chromia too. Infact all Binance coin just dey vex, all dey give two digits returns with very special ones giving three digit returns. They market dey very positive, any coin wey you buy fit turn u big boy in mata of weeks.


Bro no worry too much, That SYS coin don drop small. The news na in 2 days sha. I believe say e go resume pump soon. The surprising thing be say I miss out on those pumps. I been no wan jump in come catch falling knife. Even that MFT you talk about pump about 100%.