Hello Omo Iya.
My name na Olufemi and Posi nah my son name
Abi male in gender
from the green white green, Ogun precisely
Post my
artwork for a contest and i go need ham for your support .
Welcome brother Posi, I see say you been don wear stable coin avatar for tey tey, you be baba for here wey go carry some of us along. You try.
I don notice say na only 9ja dry show themselves for here, no other African countries don show face? As the thread says Africa. Shah, we still dey open our big eye dey wait for other African.
My people, make una shook eye put for Electroneum (ETN). Na better coin and the price dey too cheap as e bi now sef. You fit buy recharge card and pay for other utilities with am sef. Even people like Posi fit sell their drawing and digital skills on their portal in exchange for ETN.
@mpamaegbu, this electroneum, being don dey my eye since 2017 when bull run never start, I missed am, as you don show us expo now, na the Betta time to jump in now, make I buy some of the coin. How you see am?