Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: African bitcointalk community hangout
by
CryptopreneurBrainboss
on 24/07/2020, 16:58:50 UTC
My people, make una shook eye put for Electroneum (ETN). Na better coin and the price dey too cheap as e bi now sef. You fit buy recharge card and pay for other utilities with am sef. Even people like Posi fit sell their drawing and digital skills on their portal in exchange for ETN.

ETN still dey alive? I remember dat year wey dey no go let persin hear something with this mobile mining wey make the project blow die although the bear market for 2018/2019 hit dem hard but hope dey recover sha. Dey been get unique idea as the first mobile minable coin but now Dem don full everywhere but just hope ETN do well for your sake as I believe you did don buy am.


Ah no big today Posi identify himself as Nigerian na, I know since. Abeg make una go show am support, the artwork make sense die as I just view am. Kudos bro just hope you win and if e become reality no forget to inform us make we join you celebrate. Good-looking.

Welcome @Traderbtcc, spread the news about this thread make we plenty as with numbers anything we request for them go lend us hearings ear.