Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: African bitcointalk community hangout
by
nelson4lov
on 27/07/2020, 18:35:05 UTC
My people, shey una don see Bitcoin for him true form – A beast. I also hope say una no own altcoins at this time because na bloodbath since yesterday. See ARPA don drop below 200 sats for this first time in the last 2 months. Even Cartesi dey take severe beatings. If una wan buy, abeg just chill small make bitcoin relax small coz like this, e fot reach $12K before e retrace and e no go look funny for altcoins.
Post my artwork for a contest and i go need ham for your support .

Oga Posi, well done. You try for that artwork. I no go lie or sugar coat am but e nice. Incase anything pop and you need community support, we dey behind us on this 🙏




~
My people, make una shook eye put for Electroneum (ETN). Na better coin and the price dey too cheap as e bi now sef. You fit buy recharge card and pay for other utilities with am sef. Even people like Posi fit sell their drawing and digital skills on their portal in exchange for ETN.

I never touch or hold ETN since their ICO then. Na because say their initial product, Mobile Mining been no work as expected. But that one aside, I go check their new products. That their amytask product look interesting for me.