@ Josefjix and Gozie51. You talk sense, I have it for mind make I create writeup for Africa ATMs. Only 1 ATM dey Nigeria, so to make it Africa generally na sense. Make I dey wait for other comments but I think all go suggest this too.
You sabi sey dem nor dey use mirror look wristwatch na. E go better to give the thread a wider coverage with the African umbrella to make am attract more posters since na only one ATM dey owa country as e bi na. Na my own contribution be that for this matta.
BTW, who see wetin that my darling
Curio do a few hours ago? For those of una wey buy Cartesi, make una nor panic as e bi now sey e don drop shikini Satoshi. Na the effect of the last bounty distribution cause am wey dem distribute on July 23. Look for any angle to buy more. Na better coin be that. Also, I dey observe that ETN for better buy. All these coins dem be use-case coins.