Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: African bitcointalk community hangout
by
Gozie51
on 05/08/2020, 12:45:39 UTC
The trick na be say instead of to patronize the ponzi, I buy the coin. Ethereum get future oh make I just highlight am. If any coin fit reach bitcoin (four/five digit price) while bitcoin increase more na ethereum especially as this der upgrade dey come


The very day BrainBoss talk this thing I been no get much money to buy Ethereum, but I try my best convinced my friend with tangible reason why Ethereum go fit increase price soon, him see my reason legit come drop money take buy 1 eth, now him the smile with the price.
Na why I wan thank am personally and to every other person for una contribution and suggestions, our growth for this forum na the love we get for each other be the fertilizer. I throw Salute for all of una

Na im be say I go just try hodl my very small fraction of etheruem wey I get from bounty tight just like monkey hold the branch of tree tight  Grin Etheruem dey really tell us say na im be numba 2 for the crypto parole.
I remember litecoin too back then wey dey follow etheruem bumpa to bumpa. Litecoin dey $58 as I dey write, e be like say im own time dey come just say na bitcoin dey overshadow am big time