Lol becky. I understand the message wey gozie dey try pass across. No doubt say our chairman, Brainboss, don do very well. A lot of people do sleep for night with happiness and a filled stomach because of am. For me, Gozie post dey try yarn say if those people him quote succeed regardless of the obstacles them been face, then we no suppose give up or feel bad whenever things no dey work out as planned. But that's by the way.
I greet everyone for the house. I been wan come officially tell the house say local man been don finally reach hero rank and e for no dey possible without una support so I thank una. The reason I never dey active here much be say, I been dey seriously sick. I still dey try recover and I been get burnout from coding (burnout mean say I code till I lose motivation aka my fuel run dry) so I dey try recover from both my sickness and burnout at the moment.
I hope say una dey safe from the market dumps wey happen offer the last couple of days. Some blood stain me but na just another day in the market. Soon the market go get relief rally. The only problem be say, when e don dey get towards the end of the year, market dey usually go down as much people dey cash out to use the funds enjoy with their family so make we try dey vigilant.