STAKING AND ITS PROFITABILITY
Una gudmoni my people, I just want us to discus dis issue wey I tink many of us don dey do but some never start or hear am. De altcoins still dey down and dis is de time to get into staking, staking can earn u many many profit wey trading cannot give except dose wey sarbi well-well. So, if u never dey gud in trading abeg make u shift ur yash to staking of altcoins now.
Here are some few altcoins wey fit give gud profit in short-term: KAVA, TRON, ATOM, TEZOS among others, why I chose dose ones bi sey, dey cheap for market now nd na opportunity for anybody to buy dem for staking. Me kum-kuma dey use Trust wallet so I dey stake for dere.
Tell us more about staking make we pinkins learn.