Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: African bitcointalk community hangout
by
Lordhermes
on 12/09/2020, 21:55:28 UTC
I greet everyone for the house. I been wan come officially tell the house say local man been don finally reach hero rank and e for no dey possible without una support so I thank una. The reason I never dey active here much be say, I been dey seriously sick. I still dey try recover and I been get burnout from coding (burnout mean say I code till I lose motivation aka my fuel run dry) so I dey try recover from both my sickness and burnout at the moment.
You be one person I dread on this reputable forum wey no ways, I dey try hard to work up to you as baba wey don't dey here for long, omoh, nelson4lov you try major, congrats on your Hero rank Boss, you too much, well done,I dey proud of you and this show say any thing you air out for here say make we do and follow, na the thing I go do. 
<...>
This na secret wey I been dey find since, as the market dey red everywhere, na the best option be this I swear down, among these coin you list down, me I prefer ATOM not because of the ROI percentage but because of the project itself, I watched ATOM at $1.5 price but now na around $5.6, also them get tiny withdrawal fee and high volume and volatility, I never stake before so I go use trust wallet as you talk make I partake.