Thank you a lot my brothers and sister wey dey this place. Me I happy wells as I come across this particular group my mind really come down badly Because I be very new person for this place and Dey believe say one day everywhere go really good and beside make we all put heads together and see Wetin we fit do wey go really move this group forward and una wey already Dey so much ahead of us make una try file complain so dem fit reduce the complexity of the site. But as e Dey be make una try carry me along this journey as me I ready bring my head down. Una thank you
I never change my name still remain @celebrityfarmer
I greet you my brother and welcome to the forum ooo, good thing say you locate your root here and congratulations on that one.
On the other hand, I go like to let you know say to come dey send compliant messages to thymos (Abi wetin be him name self) say make him and his team reduce the complexity of this forum go be like person wey look stone finish, come carry water dey pour on top hoping say e go desolve, you know say that one na fruitless journey, my only advice na, any thing wey you no understand for the forum, we dey here for you, just ask here, the first person wey see your query go surly help you out, and i also want make you know say no body know everything here ooo, we all na still leaner in one way or other, so the way forward na for us to always dey help each other...so welcome once again my brother, hope you enjoy your stay here.