Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigerian Bitcointalk Community Hangout. {Current topic: #EndSARs}
by
CryptopreneurBrainboss
on 22/10/2020, 23:24:01 UTC
So see wetin happen wey make thread don change. We Nigerians we sabi carry Africa for head but others no dey reasons us like dat. E come be like we dey waste our time for here as na only we we dey here. Some people come reason me say make we fight for our own first then we fit fight fight for odas and I come see sense for wetin dey talk na e make I sharp sharp change the thread to focus more us, Nigerians.

As e be now eh, the agenda never change as na to get our own local board be the priority, if we fit achieve am everywhere go strew for us. We just need to dey very active atleast once a week for the thread and contribute towards the matter wey we dey address.

NEW TOPIC: How we go fit end bad governance for we country, no be just to EndSARs.

Person wey e reply make sense die go recieve awoof merit from me. If you see reply wey interest you then follow encourage the person too.