Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigerian Bitcointalk Community Hangout. {Current topic: #EndSARs}
by
Josefjix
on 01/11/2020, 12:28:10 UTC
Make una no vex oh say I no dey post here like dat, even normal forum posting dis days dey hard me. I just dey too occupied. Concerning my promise, eh I never get enough sMerit on me but I dey see wetin all of una wey participants write. When Small tin enta my hand I go do the needful just continue and keep this thread active.

Ma brodas na wah for dis country we dey inside, just imagine how the government take end the matta for ground without doing anything. Even dat mumu wey dem dey call desmond idiot (yes idiot) dey talk rubbish. E don't n clear for our eyes say the government no regard us the youths.

Anyways for music lover#MadeInLagos don finally drop atleast one good thing don from the countey of recent as na only entertainment dey do the country proud, the rest an waste.

Damian Marley and Burna go hard on those tracks Wizkid call their attention, I done give up on naija matter tey tey even we wey our parents no too get the money. Dem dey support the government base on say dem believe say na suffernness be everything. I just taya Baba