Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigerian Bitcointalk Community Hangout. {Current topic: #EndSARs}
by
Traderbtcc
on 02/11/2020, 08:34:02 UTC
Make una no vex oh say I no dey post here like dat, even normal forum posting dis days dey hard me. I just dey too occupied. Concerning my promise, eh I never get enough sMerit on me but I dey see wetin all of una wey participants write. When Small tin enta my hand I go do the needful just continue and keep this thread active.
No problem boss nothing do you, thanks.
Ma brodas na wah for dis country we dey inside, just imagine how the government take end the matta for ground without doing anything. Even dat mumu wey dem dey call desmond idiot (yes idiot) dey talk rubbish. E don't n clear for our eyes say the government no regard us the youths.
The thing really weak me the way government take end the matter oh, after the kin massacre for lekki toll gate, buhari just come live come talk rubbish, say make youth stop to protest, him no even cap anything about the massacre way happen on the 20th of October 2020,like this na failed state we dey, after buhari speech everybody just weak for the protest walka, 2023 election go hot sha,for Desmond Elliott him just ruin the whole childhood memories i get of am, totally disappointed
Anyways for music lover#MadeInLagos don finally drop atleast one good thing don from the countey of recent as na only entertainment dey do the country proud, the rest an waste.
I no be wizkid fan sha, buh mehn base on wetin I dey hear, omo the album wack, everywhere I go I dey hear the same thing even some wizkid fans dey vex, I also hear say the only one way mad amongst all na that "GINGER" way him feature burna boy, na that one I go find way go download confirm am sha.