I greet my fellow community members this lovely evening especially our chairman, Brainboss. Abeg, I wan apologize to the house for going AWOL for the past couple of weeks. School come happened so I been gats prepare for semester exams I never write for over 7 months. This country na wao Oo

Well sha, I been come to salute the house as I dey kamkpe moving forward. I go try catch up with everything wey I don miss. In the meantime, I hope una been take advantage of the recent green market in crypto? Don't forget to take profits wey you fit use for Christmas sha.