My people! Na back to back for owa main man,
CryptopreneurBrainboss! The bobo join another feather to im cap as im win
Golden Feather Award join the "Interview" award wey im win cash price last week. BB, abeg you need kill goat for us abi na catfish you go do? That cash na something oh 😏. Abeg, I nor wan bore una now with too much talk talk. Make una just see the pishure below or check the result sheet here
SpreadsheetBrainboss still make top nominations for other categories too. Well done, bro! You deserve am.
Brainboss done turn to something else for bitcointalk lately ooo and him try to win so many awards inside this arena, me self day wish to be like the guy when I grow. Baba crypto for 9ja.