Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Nigerian Bitcointalk Community Hangout. {Current topic: #EndSARs}
by
Traderbtcc
on 23/12/2020, 22:15:02 UTC
⭐ Merited by CryptopreneurBrainboss (1)
My people! Na back to back for owa main man, CryptopreneurBrainboss! The bobo join another feather to im cap as im win Golden Feather Award join the "Interview" award wey im win cash price last week. BB, abeg you need kill goat for us abi na catfish you go do? That cash na something oh 😏. Abeg, I nor wan bore una now with too much talk talk. Make una just see the pishure below or check the result sheet here Spreadsheet


Brainboss still make top nominations for other categories too. Well done, bro! You deserve am.
Wow, another achievement for own boss man @CryptopreneurBrainboss,congrats boss, I believe say more go come na the starting be this, them go hear am for this forum Cheesy, naija all the way Cool.
Username: Nelkel007
Gender: Male
State: Rivers State
Skills: newbie ( I dey here to learn).

Omo my guys, I dey new here,I dey post nice tinz but I no dey get merits.
Then secondly them never update my activity to ryhme with my post.
I need help jare!!
Welcome to the forum paddy, just follow the rules and you go dey okay.
And the reason why your activity no dey match with your posts count na because them dey delete your posts them,try make unique and creative posts them, no reason the starting continue to dey push.