Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Nigerian Bitcointalk Community Hangout. {Current topic: #EndSARs}
by
Mpamaegbu
on 24/12/2020, 14:01:55 UTC
⭐ Merited by CryptopreneurBrainboss (1)
Hope sey na im "pearls" still giv am dis award ni?, bad peps evarywher. I don come 2 undastad sey him wey God bless no body wey go fit cause am, nor itimidate am, my sincere greeting sir, we all tap into dis ur success dat b4 2020 end we go all colet our own blessings accordingly, once again a big Congratulations Boss, more go cum(**) 2021.
My dear, you dey mind dem. Pepper body too much for those guys side. Dem nor wan make anything Africa shy. E even worse once dem know sey na Naija. As owa bad leaders dem don paint us bad for dem eyes any good thing wey we do nor dey sweet dem for belle again. But the truth be sey when Baba God blow your whistle, my broda whether you wear Jersey or tie wrapper you go play for the game. Na so the matta be. Make I take this opportunity beg all man here sey make dem dey very careful with anything dem dey do here as many of those peeps eyes dey for owa accounts now. E go give dem excess joy to see sey dem tarnish owa imagine with red as I dey see dem. Make una shine eyes like pussy oh and reason the matta wella wey I just throwey for ground now.

One love my people! Feliz navidad...(Felix Na dibia 🤣)