From the two charts I go fit understand say we dey try well well for posting but we gat put am oil and grease, if we go comot shame come here yarn better talk, we for don reach far tey tey.
For the merit chart, we no too dey chest merit like water for here base on say na only one source we get, if to say source plenty kperere, we for don reach far for the chart, no be lie.
Base on the merit matter, na true talk you talk say, na just one source we get and that na Brainboss. People way don reach o apply, make them apply but na liver shah at least, Brainboss fit yarn una as e be so, nothing go spoil if una update am before una try. Na the matter.
From watin i dey see there, i believe say that statistics way dey there so na mainly based on the meriting way dey go on for this our small corner and the way we dey yarn kwa na em display there so. Na the matter we dey cry on be that. Here no dey sweet me the way e suppose dey sweet person, e con be like say, ns the same work we dey struggle to produce talk we dey do here. Na the bonus post place be this o, make we use am wella.