Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigerian Bitcointalk Community Hangout. {Current topic: NIN & Local board}
by
Smartvirus
on 17/02/2021, 21:41:22 UTC
Access Bank, GTBank begin closing customer accounts that have traded cryptocurrency

As we hear say those two banks above are closing down retail accounts linked to crypto exchanges, hope any of you never dey affected. I mean people that make use of crypto exchange service from Nigeria. No prior warning, or na after the people wey still make use of crypto exchange service after CNB ban crypto for Naija?

Naija na prison? Or you people not affected?

https://techcabal.com/2021/02/11/access-bank-gt-bank-closing-customer-accounts-traded-cryptocurrency/#
Oh! My brother, i dey see your struggle, you dey try fight am but, e dey hard you. If na merit journey you dey so with this our pigin eh, you for dey cry cef, hahahahahahahaha. Luckily, you na man way sabi the thing for the forum but then, as e be like you no bin dey use pigin like that for your area, e con hard you. No worry but you go dey try, at least we understand. You don read book so tayyyy, all your pigin slangs and intunation don kpafuka finish. Na small small shah, we no dey learn am, e go burst out again.

Banks way for dey fine customesrs na em dey mumu this mumu.... abeg make them get sense o though, them na slave to government shah. How e wan come be na, for the fact say, most of this accounts, na BVN we carry link am and as biometric dey so, opening new account na wahala via say, them go wan link your accounts too and e go carry wahala for body.