Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Nigerian Bitcointalk Community Hangout. {Current topic: NIN & Local board}
by
Theoboy
on 19/02/2021, 17:43:36 UTC
⭐ Merited by igehhh (1)
Brodaly as you see me so the country don tire me, people no fit speak against the government again, because the next thing government go do na to arrest them like the lekki toll gate protesters, them no care about the youth at all, jobs no dey sef youths way try dey into crypto them still Wan block the road, them way dey thief money nobody dey talk, like the snake way swallow 36mil,or the monkey way carry money run or na that one way Lai Mohammed say dragon carry money dem go borrow fly, omo we don too endure rubbish for this current government, I just wonder when e go end cause we no fit continue like this Sad.
[/quote]

Na confusion d do our country, ruled by ppl who old pass the kind country, people wey no want better thing for the country, people wey d steal our money, people wey d try suppress us to abject poverty, people wey the try kill us in silence, people wey the take some nonsense decisions. E too much for me to talk(una knw am na).
All this lies wey Dem lie about money even the one wey dem talk say 50 goats chop 50bill naira for office. E mean say the goats share the money chop 1 goat chop 1bill🤣.
And of recent dem shun the part of insecurity for the country especially for North side go enter NO BLEACHING CREAM🤣. I mean which country the do this kind thing🤣. Them shun insecurity go the fight against bleaching
Abeg make we do make d country wake up Small
My sister(s) my brothers e go end soon make we jst get hope😁