Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigerian Bitcointalk Community Hangout. {Current topic: NIN & Local board}
by
Charles-Tim
on 19/02/2021, 20:25:28 UTC
Brodaly as you see me so the country don tire me, people no fit speak against the government again, because the next thing government go do na to arrest them like the lekki toll gate protesters, them no care about the youth at all, jobs no dey sef youths way try dey into crypto them still Wan block the road, them way dey thief money nobody dey talk, like the snake way swallow 36mil,or the monkey way carry money run or na that one way Lai Mohammed say dragon carry money dem go borrow fly, omo we don too endure rubbish for this current government, I just wonder when e go end cause we no fit continue like this Sad.
[/quote]
Naija don tire people, we see how cost goods dey rise, although not surprising say e dey rise, but the rate it dey rise come worse. Naija economy enter recession again last year, we no dey recession again this year though but the inflation rate dey increase while unemployment na issue. Graduates no dey see job, na Naija I hear say going to school na for exposure say no be for job employment because where the job dey, even the president talk ham for University of Maiduguri some years back, say no job. Naija leaders like politics, they no like economy. Naija no dey produce, only depending on crude oil, na wey Naija have a long way before e go better.