Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigerian Bitcointalk Community Hangout. {Current topic: NIN & Local board}
by
CryptopreneurBrainboss
on 09/03/2021, 07:22:12 UTC
Nigeria no be country for mining except the miner get another means to generate him personal electricity and security. That go even too dey expensive to maintain. Untill when government need make him improve electricity supply and availability of security personnels, a lot of things go still dey pass us by.

Any miner dey dis country self I doubt, me don reason am tayahh if by God grace I mistakenly get my hands on mining equipment e don be for all miners for oyibo oh. The electric something no go be problem, we go go illegal although for this side na indigene something nobody go reason you. Where problem fit dey na to learn am but we go still run am, abi no be just computer pressing something lol.

Wetin be bitcoin problem self, e no wan fall small make we use our useless naira wey dey bank buy, e dey pain me ehh. Now e dey $50k plus. E no dey even carry e brothers along well, e just dey show dem small small love no major rubbers.

Assuming the love been much Ethereum for don blow go far na, anyways other get any coins una eye set for make person do small waka for the coin head see if I fit buy small.