Nigeria get the lowest electricity bill in the whole world we dey operate 0.07 per kilowatts hour for household so from de economical point of view e dey profitable to set a mining pool in this region. But De issues na be say the light is not steady, it's not reliable
Ya. The fact say na we get the lowest electricity bills no really mean much since the light sef, you go hardly see am. That's why e just be like say our bills high coz you go just dey reason say you dey pay bills for services you no receive.
Lol. Nobody fit advice this government to encourage anything that would aid the wellbeing of her citizens, just take a look at the regulation placed on crypto exchanges and banks. Omo, if person set mining equipments/firm for 9ja government go off him light I swear make we no use keyboards dey deceive ourselves. Mining no go work for 9ja.
Omo there's no need to still dey hope on this government especially since all government know na to dey concerned about anything wey go only benefit them. Mining for work for this country but government make the simple process turn into an overly complicated one. Mining fit still work but e go involve putting together many missing pieces.