Lol. Nobody fit advice this government to encourage anything that would aid the wellbeing of her citizens, just take a look at the regulation placed on crypto exchanges and banks. Omo, if person set mining equipments/firm for 9ja government go off him light I swear make we no use keyboards dey deceive ourselves. Mining no go work for 9ja.
No be lie oh, I no believe mining go fit work self, the challenges much. First you go need government approval so you fit get constant light on a low budget because if you wan run am yourself e go be for your head, dem go use bill kill you. You know say even the oyibo miners self dem no dey too profit like that immediately unless bitcoin just provoke run dey go up and e be say dem been dey hold the previous coins dem mine.
Make we just leave the mining matter as na dead end. If the OG's wey dey the game for nigeria never reason am, e must get why maybe dem don waka for am see say no way that side oh. If you noticed all of dem go trading and promotion like ambassador can of thing for projects wey relate to the industry. If you think say mining fit work for nigeria, air you own opinion, convince us wella.