Lol. Funny thing be say, people still dey wey dey collect less than 15K naira as salary for this country and them dey survive.
If dem nor be graduates dey collect dat peanuts, we still fit reason am sey dem nor go school. But graduates follow for these people wey dey collect dat peanuts oh. This nor be joke matta. Abi how much una think sey those teachers for private schools dey collect? Wetin most of dem dey collect dey in the range of that N15k — N20k. The worse part be sey wey you wan even talk to dem about online biz na still dem go begin tell you how scam full online. Dem nor dey like show interest. I dey talk from experience with people around me.