Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 5 from 4 users
Re: Nigeria Local Board {Official language, Pidgin}
by
CryptopreneurBrainboss
on 25/05/2021, 20:31:56 UTC
⭐ Merited by Mpamaegbu (2) ,igehhh (1) ,Charles-Tim (1) ,Rollbit Razer (1)
Finally update on the donation matter, big thank you to everybody wey put head together make this event wey we arrange become a success. Those wey we put for control of money wey land their side (the pickers) don complete their work therefore we get to appreciate them for d service dey render give us as a community. To una I say big thank you




To all the donations and well wishers una tank you, God no go shame una. Becky wife done finally send her gratitude and I go update una here as e dey hot. Screenshot na e we go use as I go like make una see as she talk am.


If we put head together we fit achieve greater heights, for Becky make we win dis local board matter. Give in our best and dey active for the thread.

Una weldone