FG To Ban Twitter Operation In Nigeria; Another Set Back To Bitcoin/Crypto Information?
After President Buhari controversial tweet was deleted by Jack in what seems to be a genocide, war waving, tribal and hate speech tweet. The tweet cause plenty wahala for twitter as Twitter Ng nodey carry last come dey agitate say make Jack suspend the account of we presido as dem do to Trump account. First our president deactivate comments for all him tweets as Nigerians nodey carry last dem beginning use the "quote tweet" button dey tumble our presido with different curses wey carry weight.
As of yesterday our minister of information wey be Lai Muhammad come talk say Twitter NG go stop operation for wey country for disgracing our incompetent presido, and e no end here ooo the shamless people still come twitter to tweet about the ban for the same app

. Our country na yeye.
As of yesterday #VPNs don trend for twitter as we people dey recommend both free and paid VPN for people wey no get idea should in case the ban take place by moment we go dey use VPN dey bypass....this country na cruise.
The problem now is that twitter is the fastest growing space for crypto information and now wey the ban go take place how una fit say e go take reduce crypto exposure with the current crypto restrictions in Nigeria?