Me I just dey watch I no go fit hodl bitcoin if I no get 1btc Instead I go use am invest in shitcoins and wait for 5-6 years to cash out.
Don't mean to challenge you, Engr but to save shit coins for this long time no really dey too dangerous?
Dangerous? No na for how much investment $50 abi na $100 life na risk if person must make it in life person must take risk, losing $50 or $100 Is not a big deal, most of the shitcoins wey blow today people been no reason them... When Ethereum and dogecoin was introduced to this forum many people no gre buy, the ANN was very scanty. Today people who invested are millionaires. Just invest and believe.
No be lie sha, this forum no be better place to to follow people here for investment advice, when I join crypto for 2015 been get some shitcoin like xrp, xvr etc but after my full involvement for 2017 as I come join this forum I sell all my altcoins including Ethereum, I get enough when e be around $3 but sell all and no even reason dogecoin as investment.
I just dey imagine if I still hold those coins today or even BNB wey I been dey get dem for free for Twitter giveaway wey dem dey do then like 10 10 BNB for $3 dat year if your retweet or tagged somebody for their post. I no go lie you, sometimes just do the opposite of wetin every other person dey do and you go make am.
No follow the crowd, if you believe in anything just do am, we all get different path to success no allow person block your own. Dis day, I dey reason Shiba, If any shitcoin was to become successful I strongly believe it'll be Shiba so I dey find way buy dem small small just to hold and no dey reason as an investment but throwing away small dollars, make we see how e go be.