Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria Local Board, All board discussion welcomed. {No Official Language}
by
igehhh
on 27/06/2021, 08:13:19 UTC

Omor one contest I just get notifications for, so I say make I reason una incase any qualified members dey here for the community, the rules simple. You go just predict wetin you think bitcoin go be for dat day and why you think so. If u no get hundred activity or you never recieved reach 250kposa comot body as your prediction go just be waste but for people wey don get those requirements, go try try luck dat money no be small amount oh.
Nobe juju be that innondey see my name for that LoyceV list of users with at least 250 earned merits I be na my eye, abi sentiments don dey? Abeg make una help me check I no sure say that list comprises a of all the users with at least 250 earned merits  I sure say I don end more than that pass some people wey even dey the list.. Make dem get out I no even do again  Grin

wetin dey Kano self?
Kano na the most industrial state in the country and one of the top 10 in Africa, that place nain most of these packaged foods we dey eat come out from, the state legit wella.

People dey go school dat area? I hear say dis northerner region say any money nomata wetin happen to am dey acceptable, like dem no dey select money for there, how true be dis mata?.
In the Northern states money still get value, even N5 wey no get value for South South still be major money for North, with N50 you go buy rice plus onions join, for North N5 onions, pepper and maggi still dey. N100 tuber of yam still dey too, house rent for self contain na 30k, 50k you go see legit one.

Georgejohn go there go dey quarrel problem dey this country oo  Grin