Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria Local Board, All board discussion welcomed. {No Official Language}
by
CryptopreneurBrainboss
on 11/07/2021, 23:01:07 UTC
No fear to comment even though na just one line for here, nobody go delete am especially no be me. Na unless wetin you comment turns out to be spam na wen I sure men dem here go report am to moderator to delete. Just know telegram or no telegram the donations for still hold. I no just carry am for head as then I get so many worries and dey low on cash if not me myself I get plans for our brother but even now self rubbers no dey last for person hand, so I just decide make e just dey as e dey.

Nobi the first time we don do donation for forum, my covid doings make plenty donations come forum account wey dem no been dey receive before. If I been ready say make we promote the donations, we for fit even turn Becky wife into millionaire but I just decide make e be as e be. This forum na sense e need, eye don too dey my account I just decide to no show body much before I begin enta people bad book na even wetin make me no required for local board myself. You need see my mata for other local board as dem dey discuss me, especially dat voting time.

I want fresh person so I happy for Charles bold steps although was too early and no mobilization and igehhh you talk better, abeg make we dey bump am atleast biweekly so e go dey pepper theymos eye. Dat guy too get stubborn head, who get jazzy make we lock am hahaha. Anyways na him be boss make we dey hope e hear our cry. I dun bump am (I go delete bump pen down bettee sometime again when person posts after me).