Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria Local Board, All board discussion welcomed. {No Official Language}
by
CryptopreneurBrainboss
on 13/07/2021, 14:35:01 UTC
Na so Bitcoin dey hard to buy here? Abeg who get BTC for sale jor? I need just small $250 worth.

I see ur 1st message but I think say person go don chat u up already. Well e go depend for rate oh. Me I dey available but e go depend on d price you wan offer me. Make we talk na, sha u get my contact details.

That said, I hope say una enjoy the Italy vs England match? E no too make sense like Copa American finals between Brazil vs Argentina but at least, e still go well especially since Italy fight very hard to equalize after England score very early.

Southgate abi wetin be e name na mumu, how u go use small boys go dey play penalties. E no see as Italy use mature man dem to make sure dey win. Worst part e no play Chelsea boys dem or even give them opposite to play the penalty. I Know my boys dem, dey no for disappoint until some clubs boys dem (lol, make I no call name be4 dey come attack me).

Finally Messi don win international trophy na, he can now be called a goat in my eyes. Before na only one goat I been know, d other one na mbahhh but now d two na GOAT.