Na so Bitcoin dey hard to buy here? Abeg who get BTC for sale jor? I need just small $250 worth.
N515 rate if you get interest make I know make we transact.
N505, make we run the parole.
@Brainboss, nobody chat me up. Any how. I still dey game. Anybody wey dey interested make im run me the stuff. Na direct. I go send you first.
See hodler way get plans. Watin you d9n see na my senior man, show me o make I follow you see o. Make you no con tune millionaire alone then, I go con dey worry you to pay my bills o. You cef know say e no go sure o but then, na so e just be shah. Anybody way hole am stand and ready to sell, make e throw way am for the investor. We dey together,, na so e just be.
How e dey be na my people? How things for that una area because, here way I dey eh, na everybody wan use my head o. People eye just tire for money here and as e con be say, na new environment I enter, them don chop me tire and I no fit cry for help, lol...