Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria Local Board, All board discussion welcomed. {No Official Language}
by
Smartvirus
on 14/07/2021, 21:58:15 UTC
Is there a case in which the ransom demanded for is in Bitcoin? Altcoin? Or totally Naira or other fiat?
Omo, criminal activity na one big business for we country now o. If e easy cef, government for dey collect tax for there hand and e for turn up plenty money. Money way be say eh, the revenue go add weight and the economy go swell well, lol. Unfortunately,  that no fit happen but the matter still remain say, e don too rampant. With your least strategy cef eh and I mean, plan way be say you no take time arrange am well, you go crime for the country, collect ransom and then, nobody go reason your matter pass 1week. The thing just bad anyhow and na big fk.

Luckily for everybody, bitcoin na anonymous something and anybody fit claim say, e no get or e no sabi but, criminal way mean business, e ready teach you the whole thing till you sabi finish to buy and arrange payment. Watin just dey pause this system be say, people way sabi dey focused on there G-money so, them no get time for kidnapping matter. The kidnappers na normal bandits, herdsmen way still get time for there cattle but dey carry that one as side hustle else, the matter eh, e no for get where e touch reach. Na once government for hunt every body way get bitcoin. This one way SARS been dey check phones for be like joke na, armed force men for dey check people phones scatter