Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria Local Board, All board discussion welcomed. {No Official Language}
by
CryptocurencyKing
on 23/07/2021, 10:40:29 UTC
You are highly welcome bro, and congratulations too, na im be the "information is power" wey people dey always talk, e sweet me for body well well when I see am say one of us here follow for the winners, I even happy more say the link I share for here no be in vain, at least, e produce one winner here and am really happy for you bro.

My little advice be say, if you no get anything important wey you need that chinkini money for, abeg, hold am ooh, no go sell am oo, BGL na very promising project ooh, that small $30 worth of BGL wey you win fit worth more than $30,000 dollars in the future, no go the reason am say the project dey very small now ooh, just keep the coins for your BGL wallet, find somewhere safe keep the private keys to the wallet, and totally forget about the coins for your wallet,

Here na the link for round 3 lucky draw https://bitcointalk.org/index.php?topic=5349988.0
[/quote]
Ah, my bro, na you o. If no be you eh, I swear I no for jam this awoff way just enter my hand on a gold plata so. E shock me when I see the pm, even if no be ground prize i collect cef, the amount way come out for the awoff no bad. So as e be eh, na straight up hodling o, na there I dey on qltcoin matter. Make I see watin e go turn out to be in the next 2-3 years. Men don't wise now for the crypto matter, the idea na, if the money go lose, make all go but then, if e no go be like that, make the coin just dey with hope on profit. Na so e just be bro, nothing I wan carry money do way other small founds no go solve am.

Like this eh, I don run go apply the next round way you post o, I go encourage other Nigerians way dey here to go do the same. Make we for dey collect dey go. You do well bro.