I applied last round but I no see result of the winning numbers at all make them dey try dey make the process transparent any which way I go still apply again try luck.
I read about this some weeks ago but I don forget about it, I just remember now but I no know how to join at all, I dey totally confused. Or maybe I no click on the right thread or there is need for playing bet at first.
Next time wey I participants, I no play bet oh and I believe nothing like that dey. You go just enter any numbers wey you feel go win based on wetin dey talk for their terms. I just checked belike dis round own don end so of you wan participants na to week on den make they open next round you collect number sharply.
I see some of our people don win, wetin d prize belike? E worth am like person fit buy fuel or recharge data use hold body. Also the claiming how e be, make person just highlight the whole matta make we understand am better.
Update: You see wetin I do for the reply title, if you get discussion wey you wan carry come the attention of the community you fit run your own like dat. Note say e no go affect main title thread but that wey we fit understand wetin we dey discussion currently. If you get new topic you just run am and people go reply follow make others understa say na the mata wey dey ground be dat. How u see dis suggestions?