Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Nigeria Local Board, All board discussion welcomed. {No Official Language}
by
CryptopreneurBrainboss
on 24/07/2021, 19:47:21 UTC
⭐ Merited by Charles-Tim (1)
i know i have met a brother here and i will be Glad to work with you as i have known you for long. only thing be say you no gree carry me along, show your brother man love make we survive together "Abeg cut soap so for me na" like this i dey roast for this place. But no see am say na worry i dey worry you oo.

Na hustle wey all dey hustle here oh as e dey hard you na so e dey hard me too. You think say I don reach the top, well d main challenge na how to remain for dat top as help wey for dey come normally no go dey again. Brother e no easy for anyone but with hustle we all dey strived. As you don come identify yourself and with time we begin dey see your quality contributions then wey go know how we go run am. Wida d painting for your account wetin you do?.

E snake sense, which means if anyone among us create new topic, the title go appear just like the one we dey see for your last post here. This means say if I post new topic, I go see the title while the main title is never affected. I get the explanation but I do not know how to do it. Like if I post new topic here, how the title go appear while the main title will not be affected? Or, only the moderator fit do ham like that?

I no dey like post pictures again if not I for give you visual explanation and you for understand am better but make I try write am and let me know if you get the point. If you preview your reply or used normal reply button wey go redirect you go where you go see all the options like bold, underlying, inputting picture etc. Just above there you go see subject space wey go write up starting with Re: Delete within dey there and write within you wan make e appeal as your subject titled and mata done set be dat.