For it's part, the CBN has complemented it's regular arguments against crypto currencies with the now routine assurances that Nigeria will have it's own digital currency soon.
Bitcoinnews.com
If we sabi whatsup na to ignore de rubbish wey CBN dey wan launch dey call am digital currency. dem dey just find way wey dey go fit dey monitor our money since dem see say we no wan let the whole crypto thing just die like dat. The government been dey think say if they behave like dey wan punish people wey dey run the crypto package people go fear leave am but dey no realize say na anything wey dem say make we no reason do na him we dey always wan do.
The government wan control over money again and na wetin dat digital nonsense dey about, no go believe their rubbish oh. We don already win dem. Firstly their digital naira go be centralized and no be wetin the industry dey all about. We we dey advocate decentralization and we country no go fit allow us get am if not dem go lose everything.