Already our youth don the pick interest in the industry, in every five Nigeria youth, four go don hear about bitcoin and cryptocurency then atleast 3 go dey parole with the market either by investing or trading this na just based on my own observation. You look am na wetin dey rain now, no be crypto?
Although I pity our youth as majority they misinform na e make dem dey run around they do rubbish say dem be crypto enthusiast. With just the right information, everywhere go stew.
Nor be lie, na crypto dey reign for our country because the youths don see say the government nor get them for mind at all. White collar jobs nor dey for common cos oga at the top don keep slot for him children way still dy secondary school. Internet money nai be wetin the youths don see say go fit help them escape sapa. If you really check am well, for the past three years now many Forex companies don come out way they trade for people and Nigerians dey jump into am. Some work out some nor work even some of us way dey hear na through MMM we take know Bitcoin. An average dey ready to work hard to escape poverty na information dey kill us. Na so them go carry one alt for head way nor get market cap dey shill am everywhere say them be investor those people dy hard to convince or teach something.