Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Nigeria Local Board, All board discussion welcomed. {No Official Language}
by
CryptopreneurBrainboss
on 28/08/2021, 03:15:48 UTC
⭐ Merited by adaseb (1)
Quote
Nigerian as we are, we are naturally born to be curious and mostly venture into every and anything, this character has brought riches to many Nigerians and also poverty to some, if any Ponzi appears Nigeria practically go crazy about it, and I don't know about you guys, when ever I tell someone that am into crypto-currency the persons attention is already grabbed, I think you right Nigeria needs a board for home grown discussion and knowledge sharing.

To the defense of many ehh, dem no know say na ponzi dem dey do oh although d educated ones know and na dem dey promote am pass based on say dey wan be among the first ti chop so dey fit run. When me I been run MMM package back in 2015 dat time na the first time I dey do online investment.

I no sabi wetin be ponzi. I even think say I dey do normal investment unto my eye come open. Everybody for Nigeria dey hungry, so when dey see opportunity to make extra money dey jump on top am and for people wey no sabi wetin dey happen, na dem dey surfer pass. No think say those big man no dey hungry oh because na dem patronize this ponzi them pass.

If you see millions wey big man lose for MMM eh, like when I dey see update for online dat year, you go dey see millions wey people dey Provide help and the only people wey fit get dat kind money na only Igbo businessmen or politicians.