Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria Local Board, All board discussion welcomed. {No Official Language}
by
CryptopreneurBrainboss
on 29/08/2021, 05:44:02 UTC
This is not funny at all, when the government is contributing less on the youths, yet still imposing sanction on having huge amount in ones account as EFCC collaborate with banks to query our source of income, I swear dem go search tired.

E shock you? No reason am oh as dis county don finish. Na just cruise and vibe we dey survive on as if you too reason how d country dey be you go just die comot. Nobody dey reason you for Nigeria days why you gas hustle for yourself and your household because no matta wetin you be or dey do, the moment you die go person done replace you and dey din forget your family.

EFCC dey find their own choppings na wetin dey sup be dat, dey don find boys for street now e come dey hard to catch dem as their funds no dey dey with dem again. So dey wan track through banks so dey fit dey get something demselfs chop. E dey like when SARs been don dey take losses so dey come introduced POS doings.

Well unless you no smart, I no understand why you go still dey keep funds for bank abi una no see wetin happen for Afghanistan. Money wey you Jo get control over no be ur own so all the money wey dey bank no be ur own. Keep your fund for Bitcoin and if the bear wan show, you fit trade to stablecoin still keep am for your personal wallet and just dey observe the market assuming those funds you go fit need am urgently.