Me I don dey reason am say the reason wey go make naija government dey declare people wey dey yarn true about dis insecurity and boko wahala wanted means gofment leg dey inside am. The tin tire me oo.
How dem go say some boko members don repeat and them go put them for army. This na calamity, error wey dey clear. I don begin see why pepo say na Islamic parole be this and the tin just dey waka dey come, no be small.