They are just tracking everything. Fuck their e-naira.
Gofment dey track the wrong guys. Dem all sabi demselves and those wey dey steal and commit the economic sabotage but gofment nor go gree go after dem. Na just average and below average guys dey always suffer for gofment hand with all these dem yeye policies.
Most Active Users (Top 10)
Igehhh!!! Igehhh!!! Igehhh!!!
Walahi, ororo dey your head oh. Oya, kneel down anywhere you dey right now, even if na for main road, make I pour anointing for your head join. Mehn! Nicely done data and graph. We need more of this among us. More graphic guys! So, even owa late comrade, Beckky666, still make the list as active poster months after im die go. E really show sey Beckky gave his best here d little time wey im dey with us. Na big challenge be dis for those of us wey still dey alive but dey shy away from owa own corner. Abeg, make we sit up and begin come back home like prodigal children. Nothing sweet pass home. Igehhh, you deserve betta wata for this thread and I nor get colele wata from fridge now. I must pour you enough wata once d thing show my side. Weldone, doh!