
Una see as the matta be there too. Those na local boards of three different countries – 1. France, 2. India and 3. Italy. The green lines show how many sub-boards dem get each. Some many pass the orda. But all of dem get something wey dey keep dem going. I nor even know how happy I go feel anyday wey I wake up come here to find out sey wey don join dat league. What a day it would be! Make I speak small grammar.
Be I don pour my own water for e head because d thing sweet me die.
Yes oh! I see your strong hand on top dat matta and e sweet me sey you baff and sponge im back wella. You na correct guy. You dey try for we corner, nor be some people wey dey carry wata dey pursue oyibo wey dem go dey pour am and neglect owa people here. I suppose pour am wata too, make d thing enta my fridge first. If una don ever check those orda local boards una go shock how dem dey baff demselves any any how even when dem nor make sense.
Dis Becky mata just weak me wen I see am bubba better joy say our brother been fight well for us when e still dey breath. Aswr when we achieved dis local board na him we go dedicate am too because d guys was a warrior.
I dey tell you! Nice suggestion. Dat dude deserve am. I support you on dis oh.
Me self I dey engaged like mad, I no even get time again to complete my posts but I go try dey post here too, e no easy august been busy die but we thank God say e don finish.
Lol... Una own better for there na as una nor fit miss weekly pay na. Shebi una minimum na just 10 posts and na pay per post. But I understand sey guyman wan to dey hit maximum na so dat e go complete for pocket. 🤔