Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria Local Board, All board discussion welcomed. {No Official Language}
by
Smartvirus
on 02/09/2021, 10:51:34 UTC
Main board: Naija crypto discussion (which can comprise of all news related to crypto and naija discussion

Childboard: economics, naija vibes, music, sport, politics and legal
Any board we are requesting must be similar or exactly the same as boards represented in the main forum.
Sports, vibes, music etc are all off topic discussions and 1 off topic board would cover them.
I believe crypto discuss should be split into 2, as it is in the main forum, Bitcoin discussion and Altcoin discussion.
Politics is a recurring topic of debate on this thread and would make an interesting child board as well.
E dey sweet me to see say, we no dey give up this fight, that na 0ne better thing way we dey do for ourselves and people way dey head am, I must commend una say, una dey try wella. Charlie, I don see watin you dey talk even before and now say, most of them dey make sense. If you recall cef, e get when you talk about criteria way fit make us get local board way support say, we need get childboard them plenty way normally no go sure for the forum say, e full for the other languages section. That go make for see reason why them go give us local board con convert every every to childboard to ensure say, the forum decent.

If you note, e agree wella with watin Upgrade dey talk here say, we need gets those boards but, to ensure easy discussion and better participation, e no go bad say, these childboard them, e go get part way go relate bitcoin and the forum, why others go be watij concern we country true true. So, when we come drop breaking gbege, e go dey centered on that particular part way dey of concern and person way wan get the latest tori for that side, e no go hard am to fine.

On the matter way concern watin we go name the board, me go like make we go with the kontry name way be Nigera. Other African kontries dey speak pighin too but, na only one naija we get and when kontryman see e kontry name for anywhere, e no go hard am to fine am say, watin dey here fit concern me. Una welcome!