Welcome

Una welcome enta campaign wey men dem dey, d thing give me joy as I see say na two Nigerian get the two slots. Our progress for the forum dey give me joy. Everywhere we dey, na so e suppose be. Funny say two of una PM me after una apply and na two of una get the slots. As my broda Mpamaegbu been ask baba, God don answer fat prayer na, u don join the oli money gang, na chipmixer remain for we to conquer, the moment one person enta way don open been dat because our quality for this forum no be here, we dey invest our time wella.
Somebody (name withheld) reason me to air my voice for the alt account of a thing wey don dey too much for the forum. See ehh alt no bad, you get one wey you dey use follow body dey normal provided say you no cheat, like meriting yourself or trusting urself even the worst wey be joining same campaign with am.
But when you come dey create account everyday like na water u dey drink, come dey spam, no be only your time you the waste but you dey put all your account at risk. Develop your account, u self go enjoy am. Make person no com dey beg tomorrow say make we reason e mata because me I go just lock up. Make una dey wise small, greediness na him dey kill Nigerian pass make we no carry am enta here abeg.